
Cameroon don win di third place medal for di ongoing Afcon 2021 afta dem beat Burkina Faso 5-3 on penalties.
Di game bin enta penalty afta di two sides draw 3-3 at di end of full time.
Na di second time for di ongoing 2021 Africa Cup of Nations, wey hosts Cameroon meet wit Burkina Faso.
Unlike wen dem meet for group stage, dis time di Bronze medal bin dey at stake to crown di team wey go finish third for Afcon 2021.
Wen dem bin first meet for di opening fixture of di tournament, di Indomitable Lions come from behind to defeat di Stallions 2-1 for di Ahmadou Ahidjo Stadium.
Hosts, Cameroon bin dey hope to compensate dia kontrimen afta dem lose 3-1 on penalties to Egypt for di semi-final.
Di wounded Indomitable Lions don play for two, third-place play-off match – dem don win one and lose di oda.
Meanwhile Burkina Faso bin dey all out for revenge and to make sure dem no lose to Cameroon two times for di same competition.
Coach Kamou Malo bin dey confident of di progress di Stallions bin don make despite dia 3-1 semi-final defeat against Senegal. Dat match na di third time wey Burkina Faso go make semi-final for di last four Afcon.
Di Stallions bin dey hope to secure anoda third-place finish like dem bin do for 2017 Afcon wia dem beat Ghana 1-0.
Di match take place for di Stade Ahmadou Ahidjo for Yaoundé and e start by 20:00 GMT. (BBC Pidgin English)